#BAD BELLE PEOPLE GO SOON TAYA...
Anything wey I touch, naso e dey turn to blessing...
You dey see that porche? Na dawan I go tey start my flexing.
Dem dey think say dem fit drown our dreams...
But dem nor know say we be bubbles, we yus dey swim.
Make dem just kpomkpi dey observe sha, I dey come...
For all those kparakpors wey kack-cos I be God-pikin son.
Trouble be dey sleep, naso yanga go wake am...
Una say talk e cheap, yes oh, na me geh the knife and yam.
As e be so ehn, I nor even dey worry for wetin dem dey yan again...
You know why? Cos I nor geh time to talk or bargain.
I nor even send dem sef-cos dem nor be text...
When dem dun taya to talk, dem go rest.
Dem never know say I fit waka pass through gbege.
Dem go soon dey rush me like bread for agege.
Las las, e go shock ollof dem how we tey comot from this kpalava.
Then, dem no go get "choose" but to dey hala ''see wahala!"- Bejide Gbenga(Speaking Pen)
22 MAY 2019 AT 19:00